Whaleshares Logo

We come yan una boku enjoyment wey dey Cross-Chain Whaletoken Rewards

beyondbitcoinpdgPosted for Everyone to comment on, 5 years ago7 min read

Whaleshares-CCTI.jpg

E don tey wey we don believe say to find synergy between blockchain go create yafu yafu opportunity way go allow us fit build beta partnership way go tay well well way go make eferibody wey gather join do am life beta. As we dey take share wetin we get with plenty people naso plenty beta beta thing go dey come our side than make us dey do am alone

With all the story wey we don yarn for up, we wan make una sabi about our cross-chain Token initiative wey don tanda gidigba full ground.

Whaleshares :repeat: EOS

Plenty development don dey happen untop EOS ecosystem and as a per say eferibody don no say whaleshares na the beta platform wey dey help people way dey use the application (App/dApps) wey dey ground. Apart say the platform dey support pesin, he dey also give wetin other platform no fit do- the cross-chain reward tokens na ogbonge thing wey partner application fit dey use their token and wey be say e go dey add beta to their network. Whaleshare go stand gidigba and enjoy beta say them dey render service ontop the EOS ecosystem, he go kan make whaleshares brand go so tay he go make token get beta value untop him head.

For the month wey don pass na 2,000,000 WLS we commot from unclaimed reserve come put am for one side so we go fit put am inside cross chain token initiative account @ccti.

This ogbonge service go allow EOS and Telos app token to fit reward wetin dey untop whaleshares. So as to make this reward fit reach everybody, them don program am to dey reward everybody once for inside the 24 hours. As we don do am like dat, na over 1,000 people wey dey use whaleshares go fit join body enjoy the reward wey this community account dey give for inside 24 hours.

The community go come use the token wey them collect to dey service the chain token initiative account and to dey finance the partners services back. As them dey do this, na so so beta thing people go dey talk about the service and as this one dey happen, na so whaleshares go dey grow with the people wey also gather partner with them.


Our First Cross-Chain Token Partners

Make u na join me welcome the first EOS token partner wey we get for whaleshares, them be; @discussions.app and @biod. As from today, we go fit dey use ATMOS and BOID token to dey give beta something for wetin we do untop whaleshares.

Discussions.App

Discussions.App is an experimental Reddit-style forum built on EOS by the @Novusphere Community that runs natively on EOS blockchain. Content posted on Discussions may be rewarded through token tips and most EOS tokens are supported for tipping including the native ATMOS token.

Discussions.App go fit allow us to get dey get extra token rewards on top any EOS thing wey we write. If we dey write anything wey come go involve EOS matter ontop whaleshalres, we go put am for the confirm channel ontop discussion.Apps, we fit get something say we do am from APP teams, he fit be say na token dem go give us abi na even ATMOS tokens them go give us. You see say na beta partnership we dey so and who dey chop yafun yafun wella.

100 ATMOS Tokens na hin una go take sama una self @ccti reward.

Make u na check the post wey them take yan say them don come and make una make sure say una dey follow them so as to know wetin dey happen for their side too... Contest fit dey happen, beta fit show face anytimes, ego beta make una follow now!
https://whaleshares.io/@discussions.app/short-introduction-to-discussions-app
Website: https://discussions.app
Telegram: https://t.me/atmosforum

BOID Social Supercomputer

Una fit go read about the BOID for unto the link wey dey down down this ogbonge post.

Before we start story untop this one, make una first go download the BOID app untop una phone abi na una computer, make una come create account, after that one, make una join one group and come start to collect BOID token. Na plenty group even dey untop am, u fit even join Beyondbitcoin group to dey collect extra token as reward as you take full group for the program.

100 BOID Tokens na hin una go take sama una self @ccti reward.

Make u na check the post wey them take yan say them don come and make una make sure say una dey follow them so as to know wetin dey happen for their side too... As he dey hot!
https://whaleshares.io/@boid/let-s-talk-about-boid-the-social-supercomputer
Website: https://www.boid.com
Telegram: https://t.me/Boidcom_official


Na like this we fit use cross chain token initiative account

The way wey we fit get reward from cross chain Initiative account na the same style with our whaletoken own, the only thing wey separate them be say na blockchain them day use for this one. We go come dey use the cross chain partner token for EOS abi Telos blockachain intead of us to dey use bitshares.

We need get anyone inside this two; EOS/Telos wallet , because na from there we go dey send tokens to our partners for ccwhaletoken and we go come still put wetin we write post-link/URL inside memo. Make u come confirm the transactions, and you don finish be that. You go see say them go give 1% reward for the post wey u put for memo.

image.png

Make u na note say: na only once inside 24 hours the CCTI go fit reward one person post. Even if your tokens na from other Apps, na still that once in 24 hours operation go remain. Them go return all the additional token wey person send automatically. If you go send token wey the number no correct, them go send am back automatically and you no go get reward for wetin u wan use am do.

You go see beta information about cross-chain token partner for this whaleshares site: Whaleshares.info

We go dey review our market value for our partner tokens once in a month and we go dey do some small small adjustment so e no go be say we dey do partial to make the market balance. As we dey do this thing go, the way we dey do am sef go become automatic as far as say our partner tokens don come gain ground on top EOS exchanges.

How we fit put token contracts on top our EOS wallet

In case say you no sabi how EOS wallet dey work, plenty times you go need to “show” abi “add” them the App tokens before you go fit see am inside your wallet. Make we show you one example as the thing fit do ontop the EOS-voter wallet by greymass.

image.png

You fit check out the CCTI transaction logs for this place at https://bloks.io/account/ccwhaletoken

Make u abeg follow @ccti account so as to dey current with wetin dey happen untop am.


Wetin go come dey happen after dis wan?

This time na jolly period we dey ontop whaleshares. As the week dey go, na so so plenty partner Apps go dey open their tokens for the cross-chain rewards and this step go help to dey support communities wey dey ontop whaleshares. As that one dey happen, na so we go dey pursue plenty major release ontop this platform so as to dey acquire plenty partners for all over the EOS ecosystem so as to dey ready to bring beta beta partner work wey everibody go gather enjoy untop.

Make we come together and grow together as friends network better pass and the people wey go enjoy pass na the one wey come the chain first and wey go still dey when the thing come boom. Plenty announcements still dey come... the BEST never still come make you stay alert!



The door is always open,
come join us anytime!



Stay tuned for more official announcements in the coming
days and weeks.

https://discord.gg/3pqBXKY

Please SHARE this post
to spread the news!


Whaleshares-io.png

Sign Up to join this conversation, or to start a topic of your own.
Your opinion is celebrated and welcomed, not banned or censored!